ASAKE, I TREKKED FOR YOU TO RUN — Asake Papa narrate hin tory with tears "For dis life wey we dey, pikin dey hear hin mama pass, but ...
ASAKE, I TREKKED FOR YOU TO RUN
— Asake Papa narrate hin tory with tears
"For dis life wey we dey, pikin dey hear hin mama pass, but na only God for heaven dey see everything.
Asake na still my pikin and e go always be. Yes, me and Aminat, hin mama, we waka go different ways, but na she sabi wetin make am be like dat. I try plenty times make she be my wife, but she no gree, na reasons wey she fit explain better.
Na me pay hospital bill when dem born my boy, and I dey always send money for hin upkeep when e still small, from hin baby time go reach primary school. When Asake reach eight years, I see say music dey hin blood, na im I buy hin first guitar for hin birthday.
I no vex, but e pain me. E pain me because now dem dey call me absentee papa for pikin wey I bring come dis world.
Asake, I go always dey bless you, even if I comot for dis world because na my seed you be, and you go grow, shine, and prosper."

COMMENTS