Supreme Court don remove Julius Abure as Labour Party Chairman, cancel Appeal Court ruling over leadership mata.
Supreme Court don nak Julius Abure comot as Labour Party National Chairman. Dem don cancel di Appeal Court ruling wey before bin recognize am as di correct chairman.
Di Supreme Court talk say di Appeal Court for Abuja no get right to put mouth for di mata because na party leadership issue, and e no concern court matter at all. Dem talk say di kind wahala wey concern who go lead party na internal issue, and court no suppose chook mouth for am.
Before-before, di Appeal Court for January 2025 don talk say Abure na di correct chairman, but Supreme Court don now cancel dat decision. Dem talk say di Appeal Court bin do mistake to recognize Abure as Labour Party National Chairman.
Dis gbege don dey go on for Labour Party for some months now, as dem dey drag leadership matter for court. Now wey Supreme Court don nak di final decision, e mean say Julius Abure no be chairman again.
Dis one fit change plenty things for Labour Party matter and how dem go take arrange their politics for front.
COMMENTS